Guides
|
Channels
|
Related Information
|
|
I Beg
By: Babawilly
|
- I been no beg to be born
Yet mai Mama push me out
I been no beg for una passport
Yet na Naija I bi
When I come beg for job
Dem say I need training
So I kuku beg for training
Dem say ‘Sharrap yua mouth’
- I been no beg for tribe
Yet I come from awa place
I been no beg for enemies
Yet the next village
Dem no laik us at all.
When I come ask for peace
Dem say we need justice
So I kuku beg for justice
Dem say ‘Sharrap yua mouth’.
- I been no beg for cry
Yet mai mouth full remain
I been no beg for tears
Yet e dey flow laik Benue
So I ask big man for handkerchief
E say ‘who bi yua mate’
So I kuku beg to bi im mate
E say ‘Sharrap yua mouth’.
© February 2003 - Babawilly
|
|