Joyful Ghetto Rhyming
By: Babawilly
-
Betta dey for Okra soup
Dey make me smile laik Nincompoop
If the pepper catch mai throat
Na pure water be antidote
-
Days laik dis e no get pair
Enjoyment dey flow everywhere
Smiles and laughter, peace and love
Chineke don bless from above
- Pocket full with coins and notes
Na me Oga wan promote
Mai Baffs for tailor don ready
New car dey shack mai whole bodi
- Some time sef dis life dey too sweet
Betta chop naim I juss dey eat
I don join ‘Big man’ sub group
As betta dey for Okra soup.
© April 2002 - Babawilly