NigeriaExchange
NgEX! - NigeriaExchange
Personalities

   Guides

   Channels

   Related Information
Personalities
Babawilly
Next Time

By: Babawilly

  1. You know mi?
    Go ask people
    You wan try me eh?
    Who you bi sef?
    Me and you go wear di same bow tie today.
    Na die!

  2. Na bottle you dey chop?
    Na two head you get?
    Abi na razor blade you dey wak?
    I go beat you sotey
    When you reach hospitu
    Na post mortem go bi yua treatment

  3. If yua mama born you well
    Cross dis line for ground
    So you cross eh?
    Juss wait make I loose shirt
    People hold me o!
    I fit kill person o!

  4. You don write yua will?
    Hmmmm, If I tear you slap eh
    You go see Oba in 3-D
    When last you see yua blood sef?
    Aniwe, no think am too much jare
    I go remind you the colour soon.

  5. So you bi area boy eh?
    Me eh, I bi first class regional boy
    Dis mai forehead so
    Na on top mai mama dey break palm kernel
    Wo, na teeth I dey take open Odeku
    As for Gulder
    Na eye socket I dey use.

  6. Dem don kuk mi for village o
    Bottle and knife
    No one dey enta
    You shoot me gun, na piss
    I go piss bullet comot
    Na one bone dey my right forearm
    Di bobo I punch last Friday
    Na tomorrow bi di burial

  7. Ah-ah, water for mai cloth
    Wetin I dey do for ground?
    Chai! See my teeth dey dance Ajasco for ground
    So you wan fight eh?
    O.K, prepare to die.

  8. Thank yua God
    If dis people no beg mi
    I for dislocate yua spirit from yua bodi
    Next time I no go let you off laik dat
    Next time na die!

© June 2001 - Babawilly

Mail us with questions or comments about this web site.
© 1997 - 2001 NgEX!. All rights reserved .