Phone Line
By: Babawilly
- I get phone
Di only one for di street
Each tyme e ring
I dey shout
‘Who isi dat?’
Carpenta do mi box
Make I lock am put
Di masta key nko?
Na mai neck e dey hang
- Lasisi
Im waif born Ibeji
E come ring me
From U.S
I happy
Mama Lasisi hear
Come nak me Tombo
And fain-fain fresh fish
Wey she kuk dat mornin’
- Sam ness door
Dey run im company
Without phone line
E come beg
Make I help.
For dia letter heading
See mai numba dia.
Diafor wen betta flow
Some dey touch mai hand.
- When Tim dai
Na turu mai phone dem hia
Mama Tim land
So-so cry
I come fear
Insurance moni come
Na mi kolet am
Me I no want o!
But dem dash mi mai cut.
- Love na wa
Di bess ting in di world
Rita ring John
From Paris
At midnight
Sweet nothings on my phone
They’ll marry wan day
She sent him three shirts
But for me ‘Oga’, na four
- Dis mai phone
Na genuine meal ticket
But wicked people
No want
Poor man to chop.
Dem wan gif efribodi
Phone line for dia haus
See me see trouble O!
Abi dem dey crase?
© May 2001 - Babawilly