Submitted By: Adora
First, I dey 4 all girlz skool,
which kind wahala be dat?
one minite she tell me her bele too big,
the next thing she complain she flat!
So I decided ta get tru dis by turnin 2 dance and 2 song!
I turn around and my mumsie say
"why u do everything wrong?
You think say we day send u to boarding school
to prance 4 stage like Mya?"
Tha next time I mention recording studio,
she set the roof on faya.
So I finally decided to go read book,
dis oyinbo tell me say she stressed.
di chance way nigga get to take read book, oh girl!
Vamooos! no make me depressed.
Na bcuz she want get higher mark..
na so so competition dey..
in don revise, cram all her book,
and leave nigga wit nada 4 brain.
One time I hand in my prep late,
the teacher be shittin like woh!
started naggin me n stessin me endlessly, I say,
oga/madam, na ME be your salary oh!
The last time we all go 4 disco,
I weren't feelin no heat...
I saw all this mal-co movement around me, I say,
'oyinbo...dis-is-di-beat!
So I beg if person say I no try 4 dis life,
make dem go chop shit,
bcuz di wahala wey dey 4 life..
oyinbo no fit handle it...
This rhyme was actually written by my very good friend Amina.
We both attend a girls boarding school in Buckinghamshire and are both Nigerians.
She wrote this rhyme to cheer us up as we miss home. It worked!
©Amina, May 2002