NigeriaExchange
NgEX! - NigeriaExchange
Poetry

   Guides
Submit Your Poems to Us info@ngex.com

  • NgEX Poetry Home
  •    Interesting Links
       Channels

    Poetry
    Contri Pipo
    (Country People)

    Submitted By: Arukaino Umukoro

    Money dey yab man. Sometime
    E dey bi like pepper for yansh
    Gari don cost
    She na sansa
    Na im poor man go chop?

    Naija pikin wey sabi oyinbo
    Go talk say
    “Di masses are shuffering”,
    but di tori for di matter be say
    no be we all dey go for ‘mass’
    for insai church
    abi, na efiribodi be catholic?

    Dem say uncle Sege don get church
    For insai  di Aso villa,
    She hin don become pastor?
    Abeg, make our SINators
    An’ house of representakeTIFs
    Helep mi ask am
    Make hin do beta prayer
    For dis we contri too o!

    Cos, e bi lai say our sins
    For dis obodo naija
    Don too plenty
    Maybe dat is why we de suffer…
    Gofment suppose import agric bees
    Come dis contri
    So dat e go dey flow
    Wit’ milk and honey.
    We kuku ma get cow boku
    For we north sef,
    Abi dem don start to import am too?

    Na only shit I no say
    Wi pipo no dey import…
    ‘Our contri is full of shit, man!’
    Which way, Nigeria?
    I remember say Sonny sing dat wan
    But, she hin no know say
    All of we road do spoil finish?
    Make we kuku use ahroplane, abi?

    But, na efiri day our gofment pipo
    Dey mess (for) up!
    Na how we go come do am now?
    Abeg, me ah don tire for dis Naija sef!

    © Arukaino Umukoro - April 2003

     

     

     


    Mail us with questions or comments about this web site.
    © 2003 NgEX!. All rights reserved .