NigeriaExchange
NgEX! - NigeriaExchange
LifeStyles

   Guides

   Channels

Lifestyles   -> Jokes
Molue Riding Guidelines - 20 Rules to Obey

Previous Joke - Next Joke

    Molue Riding Guidelines - 20 Rules to Obey

    1. If U carry yansh occupy two pesin seat na two pesin moni U go pay!

    2. If U wan ride Molue wey dey alao 'Staff' (people wey dey claim title wey no wan pay) ride na dat oda one wey im drifer na albino make U look.

    3. The claims of the merchant wey dey try sell U the 'Cure All' merecine on top this Molue are not necessarily the same of the Naija Rough Riders Transport PLC , its affiliates or management.

    4. If we jam pesin and U wan claim insurance U no dey ride here again after we fix moto!

    5. Abeg if ya breast don wohwoh finish no begin carry am feed pikin for here..try konsida sey oda people dey ride.

    6. If U gi conductor moni wey don tear walai talai NA SKATTA!

    7. Make U pack yuasef and yua frens make una siddon for one place cause we no wan hear dat nonsense 'My broda go pay U for back' yan!

    8. Becos U hang for doormot when U dey ride no mean sey U dey pay haf price O!

    9. We don post disclaimer incase awa seat stain, rough, or tear ya outfit for yansh when we siddon..no be by force sey U muss nak yansh for chair ride.

    10. We reserf di right to claim ya moni if we announce sey we no get change but U no gree hear word still carry Agidi enta....change na prifilej no be right!

    11. Women...una no fit sue for sesua harasmen for here because na ya word against man when people pack like sandine and U wan claim sey guys dey take style tap current...

    12. And if man wey tanda and U siddon dey take style peek inside ya cleafage nex time make U carry peg hold am or clamp ya handbag for chest

    13. Woman wey ride wiff driver for front dey subject to toasting....dat na prifilej to ride wiff my oga!!

    14. If U dey ride for night make U hold correct change becos if conductor muss turn torchlight an extra two minits to make shenj ol boy dat na extra sharj O!

    15. Molue trunk no dey open so if U get extra load know oredi sey U go pay extra for seat or roof loading.

    16. Refund no dey incase MoPol stop us seize Molue becos E no pass Road Worthiness.

    17. E get some times wey the choke button no go work well well so make una hang on well well incase conductor go need to push up or downhill make driver come remove leg from clutch chuck am one time to start.

    18. If U ride ontop rear bumper and U break am U GO PAY!

    19. Refund no dey if OPC stop us for road talk sey dem need Molue for 'operation'...U wan follo dem argue? go ahead!.....and finally....

    20. Na only drifer or conductor get otoriti to request make Molue stop make im troway small piss nak tree before we continue journey.....

      ...abi I lie?

      Submitted By Annonymous

      Top of Page

      Other Jokes Previous Joke - Next Joke


Mail us with questions or comments about this web site.
© 2001 NgEX!. All rights reserved .